- Chapter one
- 1. This na the book of Jesus papa dem, pikin of David, pikin of Abrahan
- 2. Abraham born Isaac, Isaac born Jacob, Jacob come born Judas and im people
- 3. Judas born Phares and Zara wey from Thamar come, Phares born Esron, Esron borm Aram
- 4. Aram come born Aminadab, Amindab born Naason, Maason born Salmon,
- 5. Salmon born Booz from Rachab, and Booz torchlite Ruth born Obed, Obed n aim born Jesse
- 6. Jesse born David wey later be king, and David born Solomon from woman wey im chance from Urias
- 7. Solomon born Roboam, Roboam born Abia, Abia sef born Asa,
- 8. Asa born Josaphat, Josaphat born Joram, Joran born Ozias
- 9. Ozias born Jonathan, Jonathan born Achaz, Achaz born Ezekias
- 10. Ezekias born Manasses, Manasses born Amon, Amon born Josias
- 11. Josias born Jechonias and im brother dem, na around dat time bad belle people move dem go Babylon
- 12. When dem enter Babylon, Jechonias born Salathiel, Salathiel born Zorobabel
- 13. Zorobabel born Abiud, Abiud born Eliakim, and Eliakim born Azor
- 14. Azor born Sadoc, Sadoc born Achim, Achim born Eliud
- 15. Eliud born Eleazar, Eleazar bor Matthan, and Matthan born born Jacob
- 16. Jacob born Joseph, Mary husband, who come born Jesus wey dem call Christ
- 17. So all dem generation from Abraham reach David na fourteen, and from David reach the time wey dem move go Babylon na another fourteen, and from their reach Christ anoda fourteen years.
- 18. Na so Jesus Christ Birth take happen, when dem hook Mary with Joseph, before dem begin torchlite demselfs, she come see say she don get Holyghost belle
- 19. Then Joseph, as say im just be person na, and im no wan use Mary rub am for public, im come talk say im go divorce for secret
- 20. But as he dey think am, one angel just show for im dream, come tell am say ‘Joseph, David pikin, no fear at all to marry Mary, for wetin dey her belle na Holy ghost pikin
- 21. And she go born boy and you go call am Jesus, as say n aim go free people from sins
- 22. All this dey happen, make prophet of God word no enter one chance, e talk say
- 23. E go be say, virgin go get belle and born boy and dem go name an Emmanuel, which means say God dey with us
- 24. Then Joseph, when im come wake up, im know say na God angel don word am, im come take Mary back
- 25. But im no torchlite am, till she born her first pikin wey be boy and dem call am JESUS
Chapter Two
- 1. That time when them born Jesus for Bethlehem wey dey for Judaea, when Herod be king, some wise men come show from east enter Jerusalem
- 2. Dem talk say, Wia Im dey wey dem born King of dem Jew? We sight Im star from east, n aim we come worship am
- 3. When Herod here wetin dem talk, im belle no sweet at all, even all pesin wey dey stay for Jerusalem
- 4. He come call all the chief priest dem and dem scribes put for one place, e come ask dem wia dem for born Christ
- 5. Dem tell am say na for Bethlehem wey dey for Judaea, na so prophet take talk am
- 6. Una Bethlehem wey dey for Juda, no be una chair small pass for all them prince of Juda, for una middle one Governor go commot, wey go rule my people dem fo Isreal
- 7. Herod come call the wise men enter corner, come ask dem the time wey the star show
- 8. E come send dem go Bethlehem, im talk say, make una go search for the Pikin wella, when una don find am, tell me so me sef go fit go worship am
- 9. When dem hear wetin the king talk, dem comot , na so the star come de show dem road reach where dem born Jesus put
- 10. When dem see the star, their belle enter maximum jollification
- 11. Dem come enter the house see the Pikin with Mary im mama, dem come kneel down dey worship Am, dem come pack gift give Am, gold, frankincence with myrrh
- 12. God come warn dem make dem no return go back wia dem from come, dem just take another road dey o their side
- 13. When dem don commot, one angel show for Joseph dream, tell am say, Oya wake up, carry your pikin and Im mama make una run enta Egypt, make una wait there until I show, Herod wan kill your Pikin.
- 14. When he wake, he quick carry im Pikin ad Im mama run commot for house for night
- 15. And na dere dem wait until Herod die, so that the word of God wey prophet talk no go enter one chance, when e talk say, na from Egypt I don call my Pikin
- 16. When Herod see say dem don hang am on top scale, im kpara gaan, e come send soldiers comot make dem go kill all the pikin wey dey Bethlehem and all the small towns wey follow surround am, from two years down go down, around the time wey im ask dem wise men
- 17. Then prophet Jeremiah word no visit boko haram, wen im talk say
- 18. For Rama, na im persin shout gaan come dey cry, people dey sad wella, Rachel dey cry for her pikin dem, and she no go hear because im pikin dem no dey alright
- 19. When Herod kick jerry can, the angel show again for Joseph dream when im dey Egypt
- 20. Im talk say, Standa, take ur Pikin and Im mama, make una enter Israel back,as say de people wey wan kill Am, don die
- 21. He come stand up, carry the Pikin and Im mama, dem come go Egypt back
- 22. But when im hear say na Archelaus be king for Judaea as im take over from im papa, fear enter am, even though God warn am for dream, he come turn enter other sides for Galilee
- 23. He come dey live for one city wey dem dey call Nazareth: so that prophet mouth no go bend when he talk say, dem go call Am Nazarene.
No comments:
Post a Comment